Dey gbab 1 oga wey near Prophet Muhammad, still tuatua 11 pipo join
Na SouthernVoicenews
My pipo Una gud morin. Lik dis and lik play lik play casala don wia trousa for Ughelli wet be oga kpakpata of towns, villages in d area wey dey call Ughelli North.
Nor be small sometin o, na so some moslem pipo waka go pray to their God for inside the place were dem dey halla baba God. As dem dey arrange with God how d day go waka, na so some débolo pikin, eshu or gragra thiefy thiefy pipo show. Dey even covet their face oo, con gbab the man wey be say e near God pass for the Mara.
Na gragra dem take gbab d guy o, but becos dey carry wocked azura, ratatata gun dem, d pipo nor fit kpom.
Na so dey cast 11 pipo wey com see baba Mohammed, a whole 11 pipo like say dem b meat. Dem dey kolo abi? But, bera side of d story b say, d guys wey dey shoko sha still dey hocipito. Dey never dequence,. D bóbó dem wocked share. Dey wan kpai everybody. Man dey fex.
But as we dey yan, dey say ókpó dem wey dey Ughelli neva dazu d pipó.
Na wa, but ókpó dem wey dey d area fit woz aproko pipo wey dey do dia work three days wey don waka pass.
As we dey wire dis tori so,ekelebe dem jos dey ifaro for area innocent pipo. Thief thief pipo still dey sway for d area even as killi killing pipo for quick moni still dey run mara for jungle, but Ókpó dem according to secrit pipo dem, dey collect brossbross take dey do cova.
Like dis em, fine boys dey terrorize Iwhrekpokpo, Ekrejebo, Iwhreovie. Dem dey bux pipo door krokroko dey collect any how and if anybody pem, dey kpufam. Wetin DPO for Ughelli, DPO for Agbarha-Otor, and DPO for Ufuoma com dey do na.
For Ughelli na, everybody dey fia as crime don dey on increase again.